by Mr. See Finish
Agent of failure don sabi say them no fit boot them like them boot Satan comot heaven. Demons dining with long spoons sabi say nah hand dem suppose use chop eba no be spoon. Everybody sabi wetin dey correct, but some village people dey seize some people oblongata when it matters. How person go pay school fee, do kurukere night reading still carry William Shakespeare textbook enter exam hall, walaitalai sumobilai this one no be exam, nah file transfer.
Make I ask una sef, when last una hear say dem catch person say him dey cheat for Ibadan School of History exam hall and dem actually face consequences wey go make person fear? Eh? Una no hear anything abi? That one na because little to nothing shele to dem! And na why this place dey possessed with “Knowledge Smuggling.”
“When students discover say cheating no dey bring no consequence, na sad ting.”
Bros, the matter don reach say almost every class get their own examination specialist who sabi this knowledge smuggling gan; you know, the ones wey come to exam with aid wey dem no fit show the world like say e be compulsory material. Some set sef dey show us pepper, “valiant” discovery of phone signal inside exam hall, the new edition of valiant meaning: honour among thieves
We don actually take the matter for shereshere for four years, abi how we take allow people wet we sabi say dem hijack exam go scot-free? Like he don tey wet those demon don dey ravage our school. Around FOUR TO FIVE YEARS! Yet, every time we hear dem don catch one exam boko haram, na one yamayama “stern warning” dem dey give them, abeg, if punishment no reach, why person no go cheat?
Our ogas at the top for those years dey soft-pedal this thing, thinking e go manage itself. Wait fess, me wey embrace my C with integrity, who I wan shalaye for say na because say I no sabi so black market for exam hall?
The wahala con dey multiply like ants at AAFEX. You know why? Because if your classmate cheat, dem catch am, she tomorrow him go dey waka say nothing fit happen. I been dey hear rumour sef, say continuum won dey continue the iwa were.
But who we go blame, the school sef dey take the matter slow like say e be small pikin, shey integrity sef still dey like this.
You sef, barao historian, you no small o, you pass jamb still prove to UI say you get sense, but since you don dey carry black market enter test room who go think say your ọpọlọ sharp at all. Una con develop better technology for cheating pass technology for reading. Una dey willing to destroy classmates’ academic records through shared malpractice. Most shameful part? Una don normalize am. Abeg, shey cheating become culture now?
Also Westin we go do when students no even need to read textbooks again. Why you go read when ChatGPT go do your assignment? Why learn when Google Scholar no concern you? When our agba educators wet get Phd go dey make students to teach themselves?
We con give birth to a wahala combination, AI taking away reading culture plus rampant exam malpractice = What exactly we creating here?
Abeg, this one na investment in ignorance.
But make we talk way forward jàre, do example with knowledge smugglers wey go make people afraid. Suspension no be joke. Expulsion exist for this kain thing too. Let it hurt. Publish the names, make shame catch those wey wan do am later, make we sabi say consequences dey visible.
You students sef remember say you come here com learn, prove say you don learn, not to pass anyhow. The grade no be everything if you no get the knowledge. History no be subject you go pass by luck. Read. Discuss. Understand context. That’s the work.
Yes, we understand “no snitching” mentality, but this institution is dying. If you see wetin you no suppose see during exam, open mouth.
This school of history suppose be institution of excellence. We get track record pass other discipline wet dey Art, Science sef, but who go analyse the history later, when the present don dey waka jagajaga.
Dr. Ajayi before he comot this wicked world, especially this world filled with academic frauds wey their conscience don die, he talk say “A mind that is quiet in the face of injustice, the man in him is dead”. As Mr See Finish, I go talk my own. Some dey copy so tey Satan self dey shock. You carry paper, carry phone, nah laptop remain. If you fit put laptop for your pocket and bra you go carry am enter. E for better say you carry two sure odds with your that your acceptance fee than to disgrace posterity by accepting your admission, and failing your papa and mama.
E be like say water don pass garri, if Otumophor no strike, one day Amadioha go strike. We don talk with mouth, una no hear, if we talk with anus, e go too smell. Them talk say stubborn fly go follow dead body enter grave. To all citizens of academic fraud, nah cutlass we go take chase you to SDC.
As e be now, one scapegoat no suppose graduate. Normally if SDC romance you, you go sabi say khaki no be leather. As e dey now, you go soon wear graduation gown with our good people for SDC, afterall, police nah your friend. No talk say we no tell you. Why I go dey read for library, you dey watch Korea movie and you still wan get A, no be arm robber be that, that one wan dey pass juju. Abeg, I wan yarn constituted authority, hear me out Mr HOD, hear me Out Mr Dean, hear me out Mr Registrar, hear me out Mr Dean of students affairs, hear me out Mr VC, water don pass garri, copy copy dey kill this system.














